Skip to main content

Nigeria: 'Why we attack Benue people' - Fulani herdsmen

Nigeria: Herdsmen say Benue State Attack na self defence
Herdsmen for Benue State, north central Nigeria, don tell BBC News Pidgin why dem attack Benue communities come kill people.
Di oga for Myetti Allah cattle breeders association for Benue State, Garus Gololo, tell BBC News Pidgin tori person Dooshima Abu, say di wahala start as some people attack Fulani herdsmen wey dey carry their cow comot from Benue State.
Gololo say, "as we dey relocate go Taraba State through Nassarawa State, for border town of Nengere, thief come collect 1000 cows from us, so we sef fight dem back."
On Monday 1 January 2018, tori say Fulani herdsmen attack some communities for Benue State, come kill about 20 people.
Other communities wey di fight affect na Gaambe -Tiev, Ayilamo, Turan, Umenger, Tse-Akor and Tomaater near Tse -Abi for Logo and Guma Local Government Areas.
But Gololo say, na defend di herdsmen defend dem self from thief dem wey come steal dia cow.
Di wahala don dey cook since wen di Benue State government put di anti-grazing law and dem no give Fulani herdsmen where to feed dia cow.
HerdsmanImage copyrightSTEFAN HEUNIS
Image exampleE dey common to see people wey carry cow dey waka for major towns for Nigeria

Benue youths vex for government

On Wednesday, youths for di state, don enter street dey protest for di state capital, Makurdi on top Fulani attack on New year day.
Di youths burn tyre for street and dem block major roads for di town.
Dem say, dem no go comot for street until President Muhammadu Buhari do something and "if im no fit, make im resign."
Di youth talk say di kain money and strategy wey government dey use tackle Boko Haram for North East, make im use di same for Benue State.
President Buhari enter Twitter to talk about di attack.

How di attack take happen?

Terve Akase wey bi talk-talk person for Benue State Governor, say di herdsmen bin start di attack around 9pm on New Year day reach 4am on Tuesday.
E say di attack na reaction to di new anti-open grazing law wey di state government put for ground to prevent di fight-fight wey bin don dey happen between farmers and herdsmen for di state.
After government put di law, Akase say di herdsmen "chook mouth for press say dem no gree di law."
Im say so far na 20 people don die and Myetti Allah say seven of dia members dey miss.
But Police talk talk person for Benue Command, Moses Yamu, tell BBC News Pidgin say na 17 people die. Im come talk say di police still dey investigate di matter even as dem don arrest 8 Fulani herdsmen.

Comments

Popular posts from this blog

Cup final hero Aubameyang has Arsenal dreaming of a brighter future

 Cup final hero Aubameyang has Arsenal dreaming of a brighter future Two goals from Pierre-Emerick Aubameyang saw Arsenal come from behind to beat  Chelsea  2-1 at Wembley and ensured they did not suffer the embarrassment of missing out on European football next season for the first time in 25 years. They can now plan for the 2020-21 campaign - which gets underway in just 42 days time - safe in the knowledge that they will have   Europa League   revenue coming their way. Europe’s second tier competition may not bring with it the riches of the  Champions League , but it can still bring in a decent amount of money - as the £35 million Arsenal pocketed from their run to the 2019 final proved. And for Mikel Arteta that extra money could be vital as he looks to reshape a squad that - despite this victory - is in desperate need a rebuild. What Arteta as done since walking through the doors at the Emirates Stadium has been extraordinary. It is ...
‘Igbos Are The Most Foolish Tribe In The World – MASSOB Leader, Uwazurike Founder and leader of the Movement for the Actualisation of the Sovereign State of Biafra, MASSOB, Chief Ralph Uwazurike, has described the Igbo tribe as foolish. In a chat with PUNCH, The MASSOB founder insisted that Igbo may not become Nigeria’s president because they only fight for their pocket. He recalled how Igbo was pushed aside after forming the former ruling Peoples Democratic Party, PDP, in 1999. He insisted that anyone calling for the unity of Nigeria does not mean well for the already troubled nation. His words, “Remember, it was the Igbo man that formed this PDP but they snatched it from him. Then, it was clear that an Igbo man would be the President of Nigeria. But in Jos, it was the Igbo who robbed themselves of that opportunity. The Igbo at that political event in Jos started speaking Hausa. “The Igbo started sponsoring (Olusegun) Obasanj...