Skip to main content

Nigeria: 'Why we attack Benue people' - Fulani herdsmen

Nigeria: Herdsmen say Benue State Attack na self defence
Herdsmen for Benue State, north central Nigeria, don tell BBC News Pidgin why dem attack Benue communities come kill people.
Di oga for Myetti Allah cattle breeders association for Benue State, Garus Gololo, tell BBC News Pidgin tori person Dooshima Abu, say di wahala start as some people attack Fulani herdsmen wey dey carry their cow comot from Benue State.
Gololo say, "as we dey relocate go Taraba State through Nassarawa State, for border town of Nengere, thief come collect 1000 cows from us, so we sef fight dem back."
On Monday 1 January 2018, tori say Fulani herdsmen attack some communities for Benue State, come kill about 20 people.
Other communities wey di fight affect na Gaambe -Tiev, Ayilamo, Turan, Umenger, Tse-Akor and Tomaater near Tse -Abi for Logo and Guma Local Government Areas.
But Gololo say, na defend di herdsmen defend dem self from thief dem wey come steal dia cow.
Di wahala don dey cook since wen di Benue State government put di anti-grazing law and dem no give Fulani herdsmen where to feed dia cow.
HerdsmanImage copyrightSTEFAN HEUNIS
Image exampleE dey common to see people wey carry cow dey waka for major towns for Nigeria

Benue youths vex for government

On Wednesday, youths for di state, don enter street dey protest for di state capital, Makurdi on top Fulani attack on New year day.
Di youths burn tyre for street and dem block major roads for di town.
Dem say, dem no go comot for street until President Muhammadu Buhari do something and "if im no fit, make im resign."
Di youth talk say di kain money and strategy wey government dey use tackle Boko Haram for North East, make im use di same for Benue State.
President Buhari enter Twitter to talk about di attack.

How di attack take happen?

Terve Akase wey bi talk-talk person for Benue State Governor, say di herdsmen bin start di attack around 9pm on New Year day reach 4am on Tuesday.
E say di attack na reaction to di new anti-open grazing law wey di state government put for ground to prevent di fight-fight wey bin don dey happen between farmers and herdsmen for di state.
After government put di law, Akase say di herdsmen "chook mouth for press say dem no gree di law."
Im say so far na 20 people don die and Myetti Allah say seven of dia members dey miss.
But Police talk talk person for Benue Command, Moses Yamu, tell BBC News Pidgin say na 17 people die. Im come talk say di police still dey investigate di matter even as dem don arrest 8 Fulani herdsmen.

Comments

Popular posts from this blog

  https://www.livescore.com/soccer/news/nobody-is-safe-who-should-leave-barcelona-champions-league-exit-bayern-7-ie2yb13kemo61bxs34darkj4s/
Nigeria is not Obasanjo, Buhari’s horse – Latest news Nigeria Abimbola Adelakun A year and some weeks short of the 2019 presidential election, President Muhammadu Buhari experienced the infamous black arts of sanctimony from ex-president Olusegun Obasanjo. On one or two occasions, I had joked that Obasanjo would send Buhari “the letter” as he did with his predecessor. I was therefore not surprised when he eventually fired a missive from his lofty throne as the self-appointed custodian of Nigerian virtue on Tuesday. Obasanjo, in and out of government, has built a reputation for playing the venerable role of the country’s “big daddy” and writing righteous letters is one of the few responsibilities he bestowed on himself. In January 2016, he accused members of the National Assembly of corruption and greed in one of his infamous letters, excoriating the legislative branch over their unbridled greed. Previously, in December 2013, Obasanjo fused a chain reaction against the Presi...
What is wrong with being black? By Matthew Ashimolowo Celebrating our Heritage, Confronting our Challenges Overview When you look  around  you, you could only wonder, “Has it come to this?” Should we begin to think that black people have a peculiarity with problems? In truth, an examination of the lives of black people around the world should answer this bugging question. Even though all human communities; black, white, green or red, are faced with challenges, Matthew Ashimolowo was not being out of place when he asked: “What is wrong with Being Black?” This book is divided into two parts, the first part examines the  glorious  past of the man of colour while the second part analyses the problems that have been peculiar to black people and the causes of such problems. Matthew Ashimolowo tagged the second part “Conformations and Pathologies”. It is a shame that the glorious past of the black man is not often told of. Matthew Ashimolowo has done an ex...